OYINBO MAGA PAY $1.4 million to online husband She say na true love (pictures)

21:42 Miz Osa's 0 Comments

Maga don Pay one naija guy as he don catch another mugu!
One oyinbo wey dem dey call Sarah wey don Wire over $1.4 million to
her Online lover say even though she never see this her African Love
she know say she Love am and him Love her too...

Sarah wey don Divorce twice talk this for Dr Phil show where dem
interview her....

See wetin she talk "Though the mysterious man's
accent has changed over time, and he keeps
asking for money to be wired to various different
countries, she is '95% certain' that he is telling
her the truth that although he keeps trying to
come over, they are arresting him on false
charges.'

She also talk say the man tell her say he come from Milan he come move
to US come stay there for 18 years but as of right now He don based
for Africa because of him business He first Dey South Africa but after
some time He come go Nigeria but right now Him dey Benin

The Funniest part of the tori be say Our "Mr Oslen Send am Email to
ask if she go marry am and even come call Her Mrs Olsen on top wey
make Oyibo head Scatter... Sortey She sell her House and property just
to fit send am money to solve problems....



She also talk am say when she first know am He dey talk like Italian
but now he dey talk like African she believe say him don Adapt to the
environment wey dey now..

Na that one I dey call "Maga don Pay!"


source:lindaikejiblog

0 comments:

Thanks for visiting my blog click on "post a comment" above and share your thoughts with me..

Find us on facebook